4.3 C
New York
Wednesday, June 25, 2025
HomeEntertainmentSelf Care No Get Age Limit - Charly Boy Reveals What He...

Self Care No Get Age Limit – Charly Boy Reveals What He Does to Look Young at 75

In a video he shared on his Instagram page, he revealed that he engages in self-care.

Advertisements
Veteran entertainer, Charles Oputa aka Charly Boy has revealed how he keeps his young look.
In a video he shared on his Instagram page, he revealed that he engages in self-care.
The entertainer who is 75 looks very young.
He could be seen in the video microblading at a spa and also have his grey hairs plucked.
Sharing the post, he wrote: “This grandpa eeeeeeeehn! 
 
My people, I carry myself go do small microblading, removal of all gray hair yesooo, I say make I fine small.
Do u mind?
Clean face no be crime, abeg.
Na so I siddon, dem arrange my face, touch small here, fix small there, sharp sharp. 
 
Make I tell una, this self-care no be only for small pikin or Gen Z people.
We go drag am.
Na for anybody wey value themselves.
Wey no carry Naija wahala for face. 
 
You dey take care of your car, you dey take care of your house, ur chick, why you no go take care of your face? Na him people go fist see. 
 
As we dey age, na so we suppose dey package ourselves.
No be vanity, na self-respect.
So if you see say my teeth white and my face dey shine, no talk say na filter, na maintenance. 
 
This life no hard, if you wan dey happy, start from yourself.
Make I fresh small, I no kill person 
 
If you believe say man suppose dey clean and sharp, drop your comment. 
 
Self-care no get age limit.”


Advertisements
Advertisements

Advertisements

RELATED ARTICLES

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

- Advertisment -

Most Popular

Recent Comments

Onuegbu Chuks Theophilus on Mikel Obi quits Super Eagles
Thomas H. Anderson on Roman Goddess_3
Oladimeji Emmanuel on Obama sends investors to Buhari